Tuesday, October 11, 2011

Warfarian Psalm 23...For Laughs!


Psalm 23 in pidgin English
1.      The Lord na my shepherd, I dey kampe. 
2.      E make me sidon for where better dey flow and come put me next to stream make my body thermocool. 
3.      E panel beat my soul come spray am white, come dey lead me dey go  through express road of righteousness sake of Him name.
4.      Walahi!, if I waka pass where arm robber, 419 and juju people boku, come even join okada reach valley of the shadow of death self, my body dey inside cloth. Your rod and staff nko ? Na so dem dey like back bone dey comfort me.
5.      You don prepare Egusi and Pounded yam make I chop. All my enemies dey look waa waa. You rub me for head wit Vaseline intensive lotion. my cup na River Niger wey overflow him bank.
6.      True true, better life and mercy go gum my back till I quench. And man pikin go tanda for God house from lai lai to lai lai. GOD ALMIGHTY NA YOU BIKO AMEN.

Welcome

this is www.busanga.com